Pages

Sunday 9 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 9

EPISODE 9
As I land like pilot wey no get parachute,
me just enter ghost mode *dem no dey
see me*. I just bend down near one
tank like dat, so dat me go fit use eye
take sample the area, the place be like
one abandoned duplex. My mind dey
read many things, because I just dey
wonder why I enter this kind gbege!
and matter con dey hard. But man na
man, me no go relent, I must do wetin I
fit do to save my yoruba love. Na so I
sight two men, them carry gun and
them be like soldier ant wey dey duty,
from were I dey I just calculate my steps
well, as I take wear my gun eem
condom *silencer*. Me gum wall, like
wall gecko, con waka small small reach
were dem dey, na so I shoot the first
one for head, before word fall from the
other one mouth, him too collect him
share. I con move their body put for
conner, con search around, I no even
hear any voice, the place be like grave
yard.
I hold my gun well, me con open the
door wey remote person enter the
house. As I chook head enter the house,
na so I hear gboa! for my head, my
head read star like Tom and Jerry, I dey
sure coco go grow come out. As I get
my self, my gun done enter under one
chair and the silencer don divorce my
gun, this one na big f–k up ooo. Me con
look up, na so I see person wey grab
like Davido bouncer, con carry waist as
if na Johnny Bravo. Before I know wetin
dey sup, the guy carry chair won still
knack me, na so I bend down take give
am elbow for leg and con role comot
from there. I con stand up, as I near am
make I dash am my fist, na so I recive
my own first for waist and chest, na
blood turn close-up for my mouth, as
my body shout ‘over load’. Na eem me
con give am three round of blow for
him body, the man no even shake at all,
he just do like say he put foam for body.
Na den I know say ee don red for me, I
just waka dive am, the mumu follow me
too dey run, for my mind I won do
wetin Jet Lee dey do for film. I just count
three legs for wall, con do back fleet
take go the man back, as he look back I
done already hold my gun. Na so I give
bullet for body but he con dey do like
Robocop, as he still dey struggle dey
waka come my side, na so I give am last
card, finishing for him head and con
hala ‘check up’, as he take fall go
ground.
The gun wey I shoot that time done
wake people wey dey the house, as I
dey smile say I don fall Goliath, na eem
bullet fly pass me. I no even bother to
look back, as ijump for the back of one
big chair, the chair role go back as the
chair turn shield. The shooting be like
were compound to compound dey use
banger fight, the chair wey I dey done
dey bring smoke come out. As I look na
five people I see, them done stop to
they shoot, two of them done they
waka dey come my side. Na so I use my
Bullet Messenger *gun* take shoot
them for chest, na eem I waka comot
from that place. Na so one near me, as
the man shoot, I just rush bend down
give upper cut, as I take hold am for
neck, con use the man as shield wen
him fellow people dey shoot me, the
man be like better brother keeper as he
help me collect all the bullet for body. I
just give the remain two better head
shot, as them touch ground.
I search all the rooms I no dey see any
sign of Seyi, my mind done over think
wen I open the last door I just see her. I
just stand like those three Eko statue
wey dey hail you welcome to Lagos, na
BOMB dey my yoruba love body. I waka
near her, as I comot the celletape wey
dey her mouth. “Baby please don’t
touch it’ Seyi dey yarn. *her eyes done
soak with pipe borne water*. I no talk
anything as I waka go find phone, I
collect one from one man like dat wen
don puff. I dial Ufousky number, the
thing say *the number your trying to
call is incorrect, please check the
number and dail again*, my mind fly, I
try another one before the number con
go, na so he carry phone.
“Hello, who’s on phone” Ufousky dey
yarn. Na me Big T. “You never die, abeg
the motor still dey if na wetin you want
be that” Ufousky dey yarn. Abeg I wan
make you help me diffuse one bomb
wey dey my girl body *na so I describe
am the type of bomb for am*. “Ok take
better deep breathe” Ufousky dey yarn.
I do do am. “Good, na how many wire
you dey sight” Ufousky dey yarn. The
wire many ooo. “Omo see gobe, na how
many red dey there” Ufousky dey yarn.
Na only one dey here. “Say you get
anything wey you fit use take cut am”
Ufousky dey yarn. Yes oo, small knife
dey my hand. “Cut the red one, and tell
me wetin happen” Ufousky dey yarn.
Hmmmmmm I still dey alive and the time
stop con start again. “Ok, na how many
minute remain” Ufousky dey yarn. Na 45
seconds. “Once the time knack 20
seconds, cut the green one” Ufousky
dey yarn. Ok I done hear
oo*23….22…..21…….baby I love
you……..20* hello Ufousky you still dey
dere because the time done stop. “Great
job! Abeg go update ur status for
facebook and coolval22.com say you
done disable bomb. You do well for me
no worry I go use number as phone a
friend for ‘Who Want To Be a Millionaire.
As me just comot the bomb from my
yoruba love chest, na so my yoruba love
hug me as if super glue dey between us.
I con notice say person dey waka enter
the room through the mirror wey dey
the room. Na Fumnanya, as I wan turn
back na so she shoot, but me just push
my girl fall as I take pull two bullet for
her chest. She just fall go ground, me
con dey happy. Na eem MR. Awotunde
just enter the room with two gun for
him hand, as he take…





To be continue

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog