Pages

Sunday 9 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 10

EPISODE 10
MR. Awotunde just enter the room with
two gun for him hand, as he take sit
down for chair wey face me and my
yoruba love. Hmmmmmmm! My mind fly
con lost like Malaysia plane, that cold
wey dey make person update weather
for two catch me. Me no even know
how the thing they do me, I need to
chop better liver, dat kind one wey
Mama Chika dey sell or else my matter
go turn Story for the Gods. “We meet
again, but this time in a decisive
moment” Mr. Awotunde dey yarn. Na so
we see am *Seyi just gum for my back*.
“I have an offer for you, this is
something that would change your life”
Mr. Awotunde dey yarn. Na wetin be the
thing. “I want you to join my team,
bring justice to its call” Mr. Awotunde
dey yarn. Dat one no fit happen, I be
one man mopol. “Well this is the
opportunity……” Mr. Awotunde dey yarn.
I no let am talk finish because plenty talk
no they full basket. Na so I quickly shoot
am before he go think about am, na
there I know say na only me waka
come. My gun just sound fiak!, bullet
done finish oooo. “I told you before,
you won’t see it coming” Mr. Awotunde
dey yarn. Na so he take shot me with
the gun wey dey him hand, na eem me
self fall go ground.
*******************
My body won peel, as I fast remove the
bullet proof wey save me. I use eye find
Seyi, I no even see her, even Mr.
Awotunde. I con run go outside, as I
take see as motor wey them they. I con
pick two gun for ground, as I pursue
the motor with my leg, na eem I con
reach were my power bike dey. Me just
tear speed as if na Etisalat Easy Blaze I
subscribe. I burst enter express as I
take they fire pursue them.
I divert go left this man block, I follow
the other side na still the same thing. Na
so I vex turn Ghost Rider, as I put speed
wey na only one tire I stand with. The
skills wey I do, make me pass am go far
and I dey sure say he no see me again.
Me con face am they drive come back as
I hold my two gun for hand, na so I take
shoot the two front tire at once. But na
God save am because he don already
slow down na so he crash go one side
of the road. Me just waka reach were he
dey, as I come down from the power
bike.
I just reach there, I open door con give
blow for head na eem he take catch my
hand, as he take knack am for staring,
he still con punch me for belle as, I fall
go back. Na eem we take position like
say na May weather vs Manny Pacquaio.
The punch no be here as we take dey
exchange am with flash share, he give
me and I give am. Body no need to
remember wetin ee dey collect, as I take
dive am go ground. Me just dey untop
the man dey pound am with blow as is
na akpu, na so he take something take
knack me,n I no know wetin be the
thing as I take fall comot for him body.
The next thing wey I see na the man
carry gun face me, as I look left and
right nothing wey I fit use take save my
self. Na so my dream won take come
thru, me just say my last prayer as I
close eyes…POH!!!!!!!
*******************
… I check my body bullet no touch, oo! I
don turn superman. Me con look up the
man just fall go one side, na my yoruba
love I see wey stand with gun. Her body
dey shake, na so I waka go meet her.
“Ololu fe mi, mo ti pa eyan *my love I
don pia person*” Seyi dey yarn. No na,
you just save my life. She just dey cry,
me con pet am as she take climb my
power bike, we con zoom comot.
Wen we reach na her place we go
straight. My mind just dey sweet me like
pikin wey dem dash packet of sugar
lick, as I done reach there, see as people
just dey hail me…BIG_T!…BIG_T!!…
BIG_T!!!…my head just dey swell as if na
me go rescue those missing girls. Me
just go collect better bathing as I run go
make call… Hello mummy. “Hello, have
been hoping to see you ever since”
mummy dey yarn. Abeg no vex for me,
how my old boy body. “Well, we are
lucky, he is still here with us, just taking
few medications and then he would be
discharged” mummy dey yarn. No worry
me go come house soon. Me just dey
happy say everything turn out well and
thanks to my behind the scene guys and
my yoruba love. As I waka enter my
house na so nepa bring light…





To be continue

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog