Pages

Sunday 9 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 8

EPISODE 8
Na so I call my mummy with another
phone. “Hello, am in the hospital now”
my malle dey talk. Wetin you dey find
there by this time or them they share
mosquito net for the place. “Not at all,
you dad was attacked by strange men,
they shot him twice, I pray he survive it”
my malle dey talk. Mummy abeg hold
body well oh, I dey come meet una very
soon. As I make the call finish, me know
let her know wetin do me so if fit avoid
stories that touch. I just beg the guy say
I wan use the first phone he no gree
until I forward am 4K.
My waka now na to go see Ufosky my
computer geek, because ee get wetin I
want make him do for me. As I drive
reach him compound, I just look the
motor well well, Whether I go see
anything wey fit give me better clue, I
just no understand because the motor
be like wetin them gbab from another
person, na so I vex carry the wallet.
I knock Ufousky compound gate, so tey
na stone I con dey use. “Kia who I be
for there” Gate man dey yarn. Na me Big
T. “Me say Big Tree, walai here no be
forest” Gate man dey yarn. Suleman you
know remember me again, abeg na
Ufousky I dey find. “Make I come
tomorrow, you go see am for Ufosky”
Gate man dey yarn. Oh this aboki won
spoil my show oo. Hmmmmmmm na so
I say ‘SAI BABA!’. “SAI BUHARI” Gate man
dey yarn. As he take open the gate for
me, I just happy.
The compound na four flats, as I knock
the door, Ufousky open am sharp sharp.
As I enter inside the room, kweke!
Kweke’, na fat be this, Ufousky you won
kill urself, anty good evening oo. As I
take greet Ufousky girlfriend wey fat
like cow, all of them con dey laugh. Me
and Ufousky con enter him workshop,
one place wey he dey do him computer
things for him house. I upload
everything wey dey do me give am. “I
don hear, wetin you dey plan to do”
Ufousky dey yarn. I just want you
update me, the location of the last call
wey I make with this phone,this wallet
check the identity of the person and
every infomate wey you fit get about
COLD KNIGHTS.
Na so ee knack the computer me just
dey chill with one bottle of origin, na so
he give me every informate wey I need
to know. The person wey get the wallet
information wey he tell me no dey
relevant at all, he no get link to COLD
KNIGHTS. “Hmmmm this ‘COLD KNIGHTS’
hard me to crack but I done run am oo,
them be dirty killers wey dey pia people
for their selfish reason and them never
even spread at all, na new gang”
Ufousky dey yarn. Ok I dey feel you,
abeg tell me more. “Mr. Awotunde be
their oga and Fumnanya be their
Squadrat Queen *second in command*,
but them get strong weak point”
Ufousky dey yarn. Tell me their weak
point *na so I draw my chair near am,
he con give me better strategy wey I go
use take treat their f–k up.
Me con give am the key of Toyota Civic
wey I pack outside, sake of say, I no
know Whether I go survive the mission.
The things wey done do me, my daddy
wey dem shoot and my yoruba love wey
dem kidnap, I know say my odd to
survive fit be 1.01 like Real Madrid vs
Genova. Me ready to die for Seyi, so dat
we country go mark my name as naija
Romeo.
My next waka na Irumole place, as I fall
in enter, he recognize my voice as he
open. Me yarn everything wey dey sup
with me. “Guy, this no be one man fight
oo, you need to report give police”
Andrew dey yarn. Abeg no worry
yourself, my head strong like cement
wey soak water, for this matter. “I get
one of my guy wey fit help you with
tools” Andrew dey yarn. Na so we enter
motor take move go 22 Coolval street,
one local setting be the place. The
person wey we go meet na Pizzaro and
Solace, as I reach there my mouth drop
water, see guns wey reach to fight
world war. Na so me take everything
wey I need join one bullet proof vest. I
still con call Ufousky wether any
changes dey. “No changes, but I go like
make you quick reach there oo”
Ufousky dey yarn. You do well as I take
cut call. Na so Pizzaro con say he get
better power bike for me and say
anything wey happen he dey my back.
**********
I just dey cruze the power bike with
better speed, as if na those android bike
games I dey play, if you be dey motor
and I drive pass you, hmmm! Na only
sound you go hear. I con drive enter
one lonely part, I con sight the location
wey Ufousky tell me, na so I take pack
the bike for bush, con trek waka reach
there. My mind dey beat but I no dey
fear at all, as I reach the gate, I waka go
the side of the compound, con jump the
fence. As I land ………*drum roles* ghen
ghen ghen ghen ghen ghen eh shin
shin shin carry pomo….




To be continue 

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog