Pages

Sunday 9 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 5

EPISODE 5
As I open one eyes take survey were I
dey, I con notice say na hospital I dey
but any way I thank God say I survive
yesterday or else nobody go fit talk the
story of Big T as ee take happen. The
ward wey I dey, plenty face wey I
recognize dey dere like few of my
compound people, Irumole and the won
wey surprise me na Fumnanya. Later
some of them discharge wey I don
manage stand up. Na eem Irumole
update me wetin happen, say dem rush
me come the hospital early in the
morning, say na now I just dey wake
up. Fumnanya just sit down near me
after she go call doctor con do check up
for me. “Well young man you are
deemed free to be discharged, due to
you were unconscious and also
sustained little bruise on your leg, and
this are your prescribed drugs for you”
Doctor Chinwe dey yarn. Na so Irumole
con pay the bill for the hospital and still
drive me and Fumnanya go my place. Na
so for motor I just drop all the things
wey happen to me to them. I con call my
yoruba love so I fit explain everything
wey happen to me for phone, she no
too para for me. When I reach
compound, the sorry wey dem dey rain
for my body pass the won wey them tell
Brazilian players after Germany beat
them 8:1 for 2014 world cup. When me
open door, Irumole con say him dey
comot, dat one no be problem and say
he do well for me.
I dey lie down wen person knock my
door, na who dey dere “it’s me
Fumnanya, can I come in” Fumnanya
dey yarn. Yes oo, the door dey open. “I
brought you yam and egg vegetable
sauce with fried plantain” Fumnanya
dey yarn. Hmmmmm you sabi the matter
and you do well for me but I no feel like
to eat. “You opt not to take your drugs
without meal, don’t worry I would eat
with you” Fumnanya dey yarn. Ok bring
bottle water from fridge, na so we chop
finish, no word come out from our
mouth except thank you and your
welcome.
Me con dey look her like DSTV wey dey
load, whether words go come out as a
sharp guy I need to break the silence. …
After many beating around the bush, I
con tell her say the way I love her be like
assignment wey I copy, wey I no fit
explain. She just dey blush, wen I put
hand for her neck, the next thing wey I
dey my mind na to kiss her na eem
remain, before I say Jack not even
Robinson, our mouth done jam each
other. We just dey like dat for one
minute, before my hand con dey explore
her body. Me con help her pull the gown
wey she wear, her body ignite my head
like say na two rock jam each other. Na
so I put mouth for her br*ast, suck am
one after the other. She con move body
go up, as I take pull her p*nt comot, her
p*ssy be like fresh palm wine wey I
need to tap. I dey suck her p*ssy join
with my finger wey dey brush inside,
her body dey vibrate like say na nokia
3310, me no gree stop until her engine
knock. Na dat tym my d*ck aka
‘spatarcus kill dem all’ ready to enter
arena, as I dey pump her, she just dey
scream ‘ovrigado’ say make I no stop. As
I wan c-m she just kneel down, collect
everytin for mouth. She just cuddle for
my body, as we dey yarn tins about life
before she con say she need to go
house before her uncle go dey find.
The night still be like baby, so I need to
chop meat, na so I waka go aboki wey
dey we area. As I reach there my phone
con dey ring, na Ifetola Gold wey we dey
work together for work call me, he tell
me say oga won see me first thing in
the morning. Aboki give me suya 500
naira and put pepper well oo. ‘Na eem
be dis’ Aboki dey yarn. Say you get POS.
“Kia me no know dat one” Aboki dey
yarn. Do make you dey support cash less
policy oo, na ur money be this. As I
match enter my compound, after I done
greet my goons dem like wrestler wey
won enter ring go fight, na so NEPA
bring light and I con dey play music
Sean Tizzle album ‘The Journey’…
I just notice some kind of noise wey no
normal, I be won lock up but my mind
no gree settle down. Na so I put ear for
window side, I con dey hear men voice
as dem dey whisper, see trouble oo,
men done con do breaking and entry
for we compound and me no get
anything to drop. As I dey gather all the
money and better things to submit wen
my turn reach, na so I hear wen dem
burst one door con ask “ni bo ni iyara
Big T wa *where Big T room dey*” One
of the Men dey yarn. I just know say ee
don red for me and I need to do
something before something do me. Na
so I carry my bed up, collect my cutlass
wey dey under there, the cutlass done
rust but na the perfect tool for the job.
As I rest body near my door, na so one
of them use leg burst the door. I no
even let am waste time, as the light self
dey on, na eem I hold the cutlass like
gladiator wey dey arena. I con use the
cutlass give am tribal mark from face
reach him hand, na so the gun fall enter
one conner. I just off light, con give am
finishing as I take pick him gun. I just
use sense come out of my room, con
squat waka go front small, wen I con
jam one of those men. For dat same
position, na eem I take pop bullet for
him body, like say na champaign, for my
mind I be like Bruce Willis, na so the
man shoot me for chest. Time to die
never reach oo because ee get many
girls wey I never pansh, runs girl wey I
never bleep, motor wey I never drive… I
con manage stand up from where I dey,
na so three men stand for my front
point me gun. ee no even tey wen I
remember their faces, say na those
armed robbers wey I jam for Mama
Gbenga store. “So na you be the Big T,
oya take this one” one of the men dey
yarn. Na so dem start to dey shoot me
like thief wey dem dey kill for firing
squad. Chia there is God oooo na so I
take die…





To Be Continue 

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog