Pages

Sunday 9 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 6

EPISODE 6
Na so I take jump comot for bed, my
body dey shake like earth worm wey
dem pour salt. I no believe say na dream
I dey because everything wey happen
be like real life. I thank God oo say na
dream. As I look time, na so I see 07:43
AM dey knack, see kasala don burst,
how I wan take reach work on time
today and my Oga wan see me … As I
manage reach my work place, I go meet
Ifetola Gold wey deliver message give
me, say where oga dey. “He’s inside the
office, probably waiting for you” Ifetola
Gold dey yarn. You do well, as I match
reach the door, my heart dey drop
sound like Mastercraft beat *one
producer like dat*, because this my oga
na Mr. Awotunde and na person wey I
done see once or twice before and any
time wey he show face na something
wan happen. ‘Good morning sir’ na so I
greet am before he look back. “What
took you so long to get to me” Mr.
Awotunde dey yarn. ‘Hmmm I be dey…’
*the words no gree comot oo*. “Well
take this letter” Mr. Awotunde dey yarn.
Thank you sir, as take I collect the letter
from him hand. “the letter is to inform
you that your service is no longer
needed in this organization hence
forth” Mr. Awotunde dey yarn. I no even
shake, as if I be dey expect am and on
top I be Big T, I go survive na time ee go
take. Na so I stone everybody for work
place the news, the thing affect them
like fuel subsidy but them no fit do
anything. I con call my yoruba love say I
won see her and I dey come her area
where she dey work as fashion
designer for one plaza like dat, say
make we meet for one eatery wey near
her.
… I dey for the eatery, dey flex my origin
as I dey watch ’30 Days in Atlanta’, my
belle won burst with laugh wen AY say
‘their father! no sorry na oyibo land we
dey, their dad!, their dad!’. As I sight Seyi
*my yoruba love*, my eyes almost turn
opolo eyes. The way she package, as if
na miss naija dem won crown, my mind
settle so tey I no remember my
problems again. Na so our body join
together. “Ololu fe mi, ki lo shele *my
love wetin happen*” Seyi dey yarn. Na
just small thing oo, how work na. “Fine
dear” Seyi dey yarn. Make you no vex
say I dey disturb you oo. “Not at all” Seyi
dey yarn. Say you remember yawa wey
gas, dat day wey you come my place.
“Yes I do, what about it” Seyi dey yarn. I
dream am oo, say dem con kill me. “God
forbid, such would never occur to you”
Seyi dey yarn. That one self dey one
conner, dem done even sack me for
work *na so she hold my two hands, as
water comot from her eyes*. “Am not
happy about all this trials your facing,
am with you till the end and what are
you going to do now” Seyi dey yarn. I
won go see my parent first thing
tomorrow. “Ok dear that’s good, I got
something for your mom”Seyi dey yarn.
…. As I waka go her store, she give 12
yards of wrapper and one bead wey.
Wey make noise before I get my self say
I done think go.
********my journey waka well, as I
take reach my parent side. Everybody
just dey hail me Big T! Big T! Big T, dat
one small self, wen all the aged people
con dey do twitter role call
#see_Big_T_of_yesterday_don_grow_oh.
I manage reach house my family dey
around, we story well. As I take give my
mummy the gift wey Seyi send for her,
she pray for her. The part wey sweet me
pass na wen my mummy make me
believe say ‘there is no place like home’,
na so she sama me better pounded yam
with banga soup followed by jack *the
dog wey dey our compound*, them
slaughter the dog because of me, I con
dey feel like prodigal son wey return.
Night reach me and my guys them, they
flex for we area, as time to sleep reach,
me just bath and I con talk to my yoruba
love phone. Me enter my room, so I fit
enjoy better sleep for once, na so I see
one letter on top my bed. The letter get
one kind blood like logo for body, when
I open am I just …




TO BE CONTINUE 

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog