Pages

Sunday 9 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 7

EPISODE 7
The letter get one kind blood like logo
for body, when I open am I just see my
name for BLOOD LETTER.
“Dear Big Timothy, you crossed the path
of the un followed. We got our eyes on
you and what we want, we shall get.
Which is blood for blood, life for life.
Your are a prey to the COLD KNIGHTS and
you must go down. You won’t see it
coming”.
Na so I look inside the room, con dey
wonder how person take put the letter
there, I go ask my people for house
Whether them see anybody wey drop
something for my room, them say no.
Sleep no gree catch me because I never
know who be this people and me never
do any body bad thing before. I know
say ee done red for me and I need to
comot for my parent place, before those
people ‘shoot bird miss him mama fly.
Before fowl make noise for morning, I
done waka comot from house so that
anybody no go know apart from my
parent, because I even beg dem make
dem no tell anybody say I don comot.
…I dey inside bus, wen driver dey knack
better song, but this track na die as my
voice loud pass ‘…no be you I carry
come but na you I go carry go’ *Kiss
Daniel ‘Woju’*. Next thing wey I notice,
the driver match brake like who Road
Safety stop, I con dey wonder, as I see
two motor wey double cross us like say
dem dey act ‘Need of Speed’ for niaja
road. Two people come down from
each of the motor and I recognize say
na those men wey come attack us for
mama Gbenga store. Na so dem shoot
gun for air, as me bend head make dem
no shoot me. Na eem dem point gun for
my head, as I look up, chia I almost cry
as na fine anty *Fumnanya* dash me
better slap with her small hand, the
sound do wiiiiiiiiiiiii for my ear, as if
person blow knockout for inside room.
Before I get my self from the slap, one
of the men knack me gun for head,
hmmm everywhere turn black and
white.
+++++++++++++++
I no even remember anything at all, my
head be like memory card wey china
phone format. As I dey get my self small
small, I notice say na chair I dey, dem tie
my hand go back, con still blind fold me.
I just dey wonder wetin I do all this
people, all my body be like load wey
heavy, as power don reduce. The big
thing wey dey my mind na Fumnanya
wey I see, this girl surprise me, she no
even act as if she know me, not even
love me.
Time pass, na so I hear the door sound
as ee open, I dey count how many leg
the person put for ground before ee go
reach my side. 1,2,3,4…..as I one count
five, na so water pour for my body. The
person no even loose the cloth wey dey
my eyes, as ee con dey interrogate me,
see beating. The most important
question wey the person dey concerned
about na ‘who I be’ and ‘who I dey
work for’. Me no even answer any one.
Until he vex go.






To be Continue 

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog