Pages

Sunday 9 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 4

EPISODE 4
…open the door I wan vex die wen na
dis my neigbour dey disturb my peace
like epan fly, wetin happen Silas. “Big T
no vex oo abeg boorow me that ‘2
Kings albulm’ so I fit play am” Silas dey
yarn. Ok I done here but take this 500
take go buy your own for White Store.
“Big T you do well oo, God go bless you.
My love na one of my padi be dat oo, so
make we chop. I almost chew my finger
join as I eat finish, the food sweet like
wetin dem use Aginomoto join Vedan
maggi cook. Na eem I remember say I
never call Fumnanya today, I con give
my yoruba love exccuse go call the babe.
As me and Fumnanya talk for phone for
like 10 minutes, she be dey para for me
but I don cool her down, wen she say
she go like com my place wic I know say
ee go spoil package, I just tell her say I
dey run some tins for my room wey
concern my work and we go meet
tomorow.
I use style buy chocholate wey my
yoruba love like well, me just open the
door, I con see wetin fit cause
earthquake for man head, my yoruba
love just were only p*nt and bra, dis girl
I dey sure say na valentine day her
parent agree to do am, because she dey
beautiful and dat her behind fit make
Timaya feature Beyonce for the remix of
‘UKU’. Next thing she waka come were I
dey con hug me, use one hand take lock
the door, my mind just dey play blues
because ee don tey wen I bang last.
“Baby it seems your avoiding me since I
came to your …”Seyi dey yarn. I no even
let her talk finish as I kiss her soft lips
wey be like bread wey don soak water,
the kiss just dey cent for the full room
wen I hijack her go bed. The wey she
dey smile be like person wey win lottery.
I pull her bra wey dey hide her br*ast,
chia! See as the thing stand like
defender wey won block free kick. I
start to dey use tongue dey ticke n cirle
her n*pple and my other hand dey
press the second br*ast, con leak her
ear enter her neck, wen my hand don
already dey untop her p*nt, dey rub her
p*ssy. As I wan pull her p*nt comot she
con say she won suck my d*ck aka
‘spatarcus kill dem all’, her mouth rap
my d*ck, my head ring as if na china
phone. Time don reach to act part two,
na so I part her leg con use my tongue
greet her p*ssy, she don dey scatter my
hair as if something loss there, she con
dey scream oo, na eem I con slot my
d*ck small small inside hey honey pot. I
rock am well, do differnt style until I
pour put for her body.
My yoruba girl just chin gum my body
for bed and still dey use my bear bear
dey play. My phone con dey ring, na
Obehi dey call me, she be church
member and my very good friend. Hello
oh baby, how you dey na. “Good
evening Brother Timothy am doing
great” Obehi dey yarn. So na wetin dey
for me. “Noting really, just called to
check on you and peharps you weren’t
present for this thursday service” Obehi
dey yarn. Abeg no mind me joor, na
work cos am but I go show face for
church tomorrow. “Ok, tomorrow is our
youth sunday and have a lovely night”
Obehi dey yarn. You do well, sleep well
oo. Sleep na one kind thing wey fit
make person late go church. Morning
tins oo, church mode activated, as my
yoruba love dey tidy house, me go buy
wetin person go chop.
…The service na helele, dat Pastor
Deborah dey preach wela but the topic
na the type wey won make me close my
yoruba love ear, na premarital s-x she
dey talk about. Well the day done dey fly
as usual, flexing must dey as my yoruba
love dey commot today. Na so we ball in
enter ‘Olori 19’ Bush Bar Lounge, we
drink, swim and con round everything
up with better s*x for the room wey we
lodge. As I wan dey excort her dey go
park, I con use ATM take vommit 10K for
my babe as transport, she just reject am
say make I no worry, say money full her
hand. My mind no sweet but no be her
first time she dey do me this thing. Na
so we do our goodbye loving kiss for
park like say na hollywood film we dey
shoot, all eyes on me as I con still dey
watch as her bus take leave park.
My wallet swell up and I no get wetin I
won go do for house, na so I call Ufusky
ma real computer geek, ee talk say he
dey one bar like dat make I con hook up
there. Ee no too tey wey my yoruba love
call me say she done reach her place, we
still talk well for phone, join the
happiness say she no flash me this time.
After many bottles of beer with one
point and kill goat, my eyes done red,
the state wey I dey I don high pass
Kilimanjaro. I hail my people for table
say I done dey go house. Me enter my
lonely street, no human being noise at
all na just crickets and rats sound I dey
hear. “Ogbeni wa si ibe bi *guy man
come this place*” areaboys voice. My
body no even respond becasue I think
say na Olamide song I dey hear ‘Voice of
the Steet’. Next thing na just two slap
update my status, all the drink wen I
done dey drink since clear from my
eyes. Na four yoruba guys wey carry
igbo dey smoke, dey my front. Na so I
remeber the money wey dey my wallet
and I need to discharge. I push one of
the guys take clear road as I dey run like
Usain Bolt, my leg dey touch my head
wen I notice say dem no dey pursue me
again. As I dey happy na so I go match
dog wey dey sleep, see me see gobe,
the battalion of dogs wey con dey chase
me, fit pursue those missing girls come
out for Sambisa forest. Na my run con
enter jar two as if na ‘Tunde on the Run’
wey be one story wey I read for
secodary school, the guy run oo but for
this place na me run pass am. As I won
divert enter one safe place na so I go
slip my leg, con fall knack NEPA pole.


To be continue 

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog