Pages

Saturday 8 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 3 (18+)

EPISODE 3

…see blood don full my body and I con

dey wonder why I no feel any pain, na

so person fall down for my side. See big

time falling hand, dis men no know say

my cloth done stain. Dem no need to tell

blind man say market dey catch fire, na

so I push the big table take cover the

same minute wey I hear the gun shot,,

as I con use eyes take survey the people

wey dey spray bullet. Na just three guys

wey were mask as one waka near us

shout say make we submit our property

one after the other. Na eem Irumole con

won stand up, I just tell am make ee

cool down watch film wey won happen.

Next tin I just say my last prayer for

planet earth and I con carry two star

empty bottle con still mark those strong

men positions, con wear the hand glove

wey I dey use for work wey dey my

pocket. I waka small small reach were

one dey just jump use the two bottle

take clap am for head before he sample

me him gun he don reach ground

already, before the second one face me

I done stone am the two broken bottle

wey dey my hand one bottle catch am

for chest while the second one meet am

for lap na so ee carry ground sit down

dey shout like goat wey dem chook

knife for neck. Na so I pick the first guy

gun, I con dive enter gutter, the last guy

just dey wonder wen Jet Lee or say na

Jackie Chan start to dey ack Nollywood,

he just stand numb dey spray bullet for

the gutter were I dey like small pikin

wey dem dash new toy gun. Me done

already crawl follow the gutter path

take find the safest root because the

last guy done dey reach were I dey. As I

wan come out of the gutter na so the

last guy point the gun for my neck, I

nearly piss for body but dat one no

move me because Irumole self dey point

the guy gun for neck. Na so my

advantage con advance go stage two

like say na Contra I dey play, me self con

come face am with the guy as police

con surround us.

Big T! Big T!! Big T!!! Turn music for my

ear like say GLO pay Psquare make them

release song wey carry Big T as for

advert for them. The people they hail my

name after we settle matter with the

police finish. Na him me self turn Robin

Hood for the area my talk dey

everywhere.

…. As Irumole drop me for front of my

compound with one of him ride Accord

‘Deadly Virus 2015 model ‘. Me greet am

bye bye sake on say him bab e dey with

am he no con branch enter my place.

Any which way na way, as I cheek my

phone missed call be like 2go credit for

my phone Seyi don give 27 missed calls,

Fumnanya too miss self, she even send

me text say I no try at all say I no fit to

call am since morning join some other

irrelevant calls. My body dey smell like

deady body wey dem no embalm

because that gutter wen I dive enter be

like succer way pit.

Me dey step leg for compound like army

wey return back from war, na so all the

certified amebo con ask “kilo she le”

*na wetin happen*. Me just dey story

dem better lie, wey dey sweet them for

ear na. Next tin wey I feel na person

wey squeeze my ear “o mo pe wa ko ko

de le no” *you no know say you

suppose reach house first* Seyi dey

yarn. She no even mind the wey I dey

smell like aboki perfume wey sour, she

hug me tight me no even care na so I

hold am join body too. I con carry her

go my room. As I enter my room every

where change, ee just be like say dem

pimp my room, no dirty all my cloth

them done already iron am, no dirty at

all, well ee no concern me but the one

wey move me na the aroma wey dey

erupt my nose. My yoruba love say you

carry party food come put for my room.

“Ra ra oo moti se oje ka le fun ee but

wa ko ko lo we ke to ma jeun*not at all

I done cook food wait for you but you

go bath first before you eat*” Seyi dey

yarn. Ok I done hear oya sereve the

food down make I go bath. As I dey

enter my room see wetin dey table, ee

be like this my yoruba love they skype

me for where she be dey, na the perfect

combination be this wey I go enjoy.

Amala with Ewedu and cat fish with my

drink Origin two bottle and maltina na

so I sit down, kiss her first, con tell her

say she be better love and con tell am

those sweet words wey dey make her

ear ring. Me won start to dey chop na so

I hear Por! Por! Por! Na who con be dis

person wey no fit allow me chop first as

I open the door I wan ….



To be Continue 

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog