Pages

Saturday 8 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 2 (18+)

EPISODE 2

Hmmmmmmm my body freeze wen I

see who open the door. I just stand still

like dat horse wey dey front of union

bank, na Fumnanya oo, see as she just

dey shine like 100 watt bulb. My eyes

scan am from head reach ground as if

na virus scan no difference with her

and coke bottle. Next tin wey I feel na

hand wey touch me “Big T good

evening and please come inside”

Fumnanya dey yarn. I step inside I no

even sight oga landlord for the palour.

“He is coming he went to take his bath”

Fumnanya dey yarn. So na who oga

landlord be to you. “Well he is my uncle,

I came to spend the semester break in

his place” Fumnanya dey yarn. Na which

school you dey. “Am a student of Osusu

Private University, studying Astronomy,

currently in my third year” Fumnanya

dey yarn. “Big T ba wo ni, ma bi nu pe

mo da e duru *how you dey no vex say

I make you dey wait*. Dat room wey

you book for before done dey vacant

oo, if you done ready I go discount am

for you” baba landlord dey yarn. I don

hear baba landlord if I don ready I go

come see you, good night oo. See this

man, na dis useless tin ee call me for or

na bad thing say I pack go my own

house for Banana island. As I dey waka

go my room Na eem I hear ‘Big T’ as I be

dey expect before na fine anty dey call

me. Me an Fumnanya con sit down for

stair case, relate well oo until mosquito

carry gallon dey hala fresh blood na so

we path way.

Morning no dey tey reach oo, today wey

be saturday I no get tins to do na eem I

call my yoruba love ‘Seyi’ ask her how

she dey and tell am were I drop key in

case she no meet me for house. Na tym

to do wetin I sabi do well oo for were

we people dey read newspaper for

morning. See argument wey dey drop

like misseles wey dem target. This Mr.

Damian na football fanatic oo, ee know

inside out even the match wey no

concern am. Based on Chelsea win na

eem men con dey rant, boil, talk tins

wey fit happen n tins wey no fit.

This hot afternoon better no gree come,

na eem I carry phone take ring Andrew

aka Irumole, Irumole na my personal

padi wey sabi d way, de only student

wey carry first class Accounting and

Finance for him set join Masters in

Womanology and no dey carry last for

any matter wey carry the #BIG_T. Guy

how far na, you no be confirm again oo.

“Abeg Big T no vex oo I get pile of work

wey nail me down for office” Andrew

dey yarn. Ok I don hear, na were you

dey self. “I dey for Mama Gbenga Store

with that chick wey I yarn you about

last time” Andrew dey yarn. No let the

babe escape because I dey come there

now.

…Irumole! Irumole! Irumole! How far na.

Big T I loyal oh, fine girl I greet you oh.

Good evening I’m Bellastone by name.

Na beta tin say I know you, my guy na

confirm oo I trust am reach ground and

abeg make you no take am play. “Sure I

won’t” Bellastone dey yarn. Na so I

stone words enter Irumole head, guy

this your girl dey bring smoke oo na dis

type of girl dey make everybody hail you

for road, na beta eye you get. “You

know the matter now” Andrew dey

yarn. Gbenga abeg sample me two

alomo bitters and one bottle water

make I drink. Me con dey yarn Irumole

tins wit him babe na so matter con

enter Fumnanya based on who Irumole

be, he give me better tips take catch the

girl. As the talk dey sweet, my phone

con bleep twice, chia this wicked flash

wey no fit show for MTN call history, as I

check am na my yoruba love. I con call

her back she tell me say she dey my

place already say make I waka dey come

fast. Me just wan put the last particles

wey setle down for my alomo bitter

bottle wen I hear POO! POO! POO! Na

gun shot be dat oo next thing wey I see

blood don full my body….


To be Continue 

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog