Pages

Saturday 8 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 1 (18+)

ADVENTURES OF BIG T
EPISODE 1
ENJOY THE STORY…
This story is written in pidgin English

Mama Chika abeg answer me before
hungry subsidize my belle for here, Big
T na wetin you wan chop, na small food
I wan eat, oyibo dey call am appetizer,
give me one plate of semovita with
vegetable soup joined by pomo wey
soak stew with two strong meat and
fish, make one bottle of origin follow
am based on step down parol with cold
pure water. “Big T this ur order no be
here oo say na you wan break the
fasting wey Jesus do for bible, na the
food be this” Mama Chika dey yarn.
Mama Chika dis your food sweet ooo,
hmmm you suppose to dey cook for
oga presido abeg show face, see dat
fine anty wey dey dat conner no collect
money from her I go pay am oo, “I don
hear oo” Mama Chika yarn back. Na em I
dey press phone as I chop finish dey
use style wait make the anty stroll go
outside so I fit relate wit am, mama
chika con collect your money oo.
“Bross I really appreciate you paying for
my meal, am grateful” fine anty dey
yarn. Oh baby dat one na small tin oo,
hope say you enjoy the food. “Yes I did”
fine anty dey yarn. My name na Timothy
but my people dey hala me BIg T. Ok am
Fumnanya by name. No vex oo I go like
see dis ur fine face again oh abi yu dey
stay we area. “Not at all I came to see
someone, where I reside is not far from
here” Fumnanya dey yarn. Ok na say you
fit sample me your control number so I
go hala you anytime. “Well I don’t give
my contact to strangers but here it is
07064*****” Fumnanya dey yarn. Ok na
me just beep you now, I go call you later
for night and make you flex well oo.
Na so tym waka pass like rat wey enter
hole, I wan go watch Chelsea match
against Manchester United for we arena
wey dey my area.
Make I yarn you who I even be self, me
na Big T as the name sound na so I be, I
dey work for one printing press. I dey
lodge for one room wey make brain oo,
I never get motor but I dey play nairabet
and baba ijebu so I fit hammer over
night and ee get two things wey I no
too like and na woman and food. As I
put leg inside the arena na so people
dey hail me oo like say na me won play
the match, I be chelsea fan de argument
won cos fight as yoruba people dey do
wetin dem sabi pass which na to shout,
my body don drip water tire because of
the spit wey dem dey rain for there. At
last I no fit happy wen chelsea win 1:0,
that Diego Coasta na confirm striker and
the assist wey Hazard do go join high
through out the season.
As I dey enter my room na em my dey
phone con dey ring, na who con be dis
one again. Chia na my yoruba love be
dis oo Seyi, she never repent from
flashing. OmO yoruba hw you dey naw,
you just sideline me oo. “Oko mi ma bi
nu *my husband no vex*” Seyi dey yarn.
So wetin dey for me now, when I go see
you again. “Olowo ori mi ma wa si odo
re lola ti month ba ti de eko *my
husband I go come your place wen I
enter lagos tomorrow*” Seyi dey yarn.
Na so we talk finish NEPA con sample us
light wen I go bath, I dey play 2 Kings
album wey Phyno and Olamide sing.
Por! Por! Por! Na who be dat wey won
break my door oo. Big T na me Silas,
landlord say make I call you oo. I don
hear make I wear cloth. Dis fine anty self
I never call am. Hello how you dey. “Am
fine” Fumnanya dey yarn… We relate
well for phone de babe don dey put
head down for me. Por! Por! Por! Oga
landlord na me be dis oo. “Am coming”
na woman voice I hear, oga landlord
don dey carry over nite abi.
Hmmmmmmm my body freeze wen I
see who open the door.
STAY TUNED FOR
EPISODE 2


No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog