Pages

Monday 10 April 2017

Adventures Of Big T – Episode 11

EPISODE 11
…As I waka enter my yoruba love house
na so nepa bring light, me just drive my
body go bathroom so I fit wash away
my sorrow. Omo see que for there,
hmmmm! Ee remain small make I ask
Whether them dey share money for the
bathroom. The person wey dey
bathroom no gree come out and no
water sound self, as I won para, na so I
see 1000 naira for ground, see me see
better. Me just shadow con watch
before I go pick am, nobody even notice
am. I just waka near the money, me
won pick am na so person pass, I just
put leg on top, con dey sing …emi lo ba
se, na me be king kong…. *Vector – king
kong*. ‘Bross say you never ready to
bath, na your turn oo’ na so one babe
like dat yarn me. Abeg no worry, you fit
go bath because I never ready. Plenty
time waka, me still dey dat spot as
people tey clear comot, me done know
say time done reach to do Western
Union Money Transfer from ground to
my pocket. I con bend down pick the
money, na so I hear PAA!, na person
knack my hand. Fear catch me like the
one wey EFCC dey catch person, me con
look up. Na so me hear, ‘say na your
own oga Big T’ na one small boy just
relay words give me. No vex I be won
use finger print take find the owner
before, me just carry my head put for
ground, as I waka carry my bucket enter
bathroom, with confirm ELA!! and
shame.
*******************
Me just carry strong face enter my
yoruba love room, me chook leg enter
inside, na so I sight wetin fit make
hungry hala MIA *Missing in Action*.
Table done set, na confirm semolina, the
wey the packaging be, I fit tell say na
semolina and no be semovita. The soup
na dat kind wey go make you wet as in
your tongue, na better bitter leaf soup
with cat fish wey still fresh and my one
bottle of origin con top am. ….as I chop
finish, my body be like say no be me get
am, na so I struggle enter bed, me greet
my yoruba love good night and warn
her say I won crash and make she no
disturb me, sake of say I won dream
better 2sure wey I go knack for Baba
Ijebu for morning.
*******************
*D.J Tenniebenson_me and my guys oh,
say we go sing song, say we go live
long* The D.J just scratch that song as
me and my guys dem enter the club. Na
big time party things for us, we just
collect centre table, na so we order for
posy*na wheel barrow wey different
type of drinks dey and na 1 million be
the price*. For the table so na me Big T,
Charlywizzy, Escaysegzy, Simzy, Doozie,
Okklad, Scholesjnr, Khola, Stanny, we dey
flex better. Me con sight won babe wey
done dey look me since, na eem I waka
go meet her, after plenty talk we con
enter room. As the babe pull cloth, my
spartacus almost tear my boxer, me just
chill as a guy man wey I be. The babe
just near me, as I done off load my
clothes, she just bend down put my
joystick for mouth, my head ring alarm. I
done almost release na so person just
bang the door open, me won stone the
person slap, why na that crucial
moment the door go open. As I look
person wey stand for door na My
Yoruba Love, na eem me burst window
come out, na so I wake up…
…As me open eyes, na eem I just gum
bed, see wetin I see, my yoruba love just
serious dey suck my d*ck, her bobby
con dey swing go up and down like
jagilova. Next thing I just hear…”Baby,
hope I did not disturb your sleep” na
Seyi dey yarn. No na, you even helep me
turn am to reality. Me con shoot
everything wey dey my d*ck enter her
mouth, as she take swallow am but
stain am small for face like pikin wey
dem feed akamu. Me con put dics two,
as I dey un top her, me con kiss her as if
tomorrow no dey before I enter her
b*east. As I put finger inside her p*ssy
na, so she shout ‘baby faster’ me na
boos for the matter, as she take c-m, all
her body con weak. Me con put my
Spartacus inside her, me rock am well
well, until shoot another load like
cannon for inside her p*ssy. Na so we
just hold each other wen sleep con
carry us go.
*******************
I still dey un top bed dey cruze sleep, as
nepa no gree take light, so the fan dey
sama my body well. Na so person take
peck me for face, me open one eye, na
my yoruba love dey my front. She done
dress up already like person wey won
comot. Na so she tell me ‘baby sorry to
wake you up, am going out to meet a
client to collect her measurement and
some other stuffs’ Seyi dey yarn. Ok I
done hear you. ‘…and I dropped 5000
naira on the table for you to use and
please don’t stay out too late’ Seyi dey
yarn.
*******************
Today na me go run this town, their
fada, warri!!!. Na so I burst enter street,
with no direction. Me con see one
poster of Scales__Man of the Year_album,
me con fall enter the shop, as I take buy
two copies. The money wey my yoruba
love give must yield something, I con
waka go one Baba Ijebu kiosk so . Me
check game wey dey play na Gold,
hmmm me con collect chart take
forecast better solid two sure. I con tell
the person wey dey terminal say make
he fire 02*39 for me and make he press
am 1000 naira.
…. As I dey stroll dey waka about like
Johnny Walker, na so two black Toyota
Amanda park for my front, the motor be
like wetin never touch ground before,
them tint the motor black. As me con
stand for one conner dey view the
motor like say I never see motor before.
Na two fine chicks con come down
from each of the motor, oboiy!!! See
assets them carry oo, them even wear
black suit, if Will Smith even see them, na
then he go use take act ‘Women on
Black. As I done tire to look, me con
press forward, na so person say ‘please,
excuse me Big T’. Na. Normal tin for
person wey popular like me but when I
look back, na those chicks call my name.
As I look back, I con dey feel like. 2baba,
maybe dem mistake call me, na so me
con press forward dey go house. Na
eem I hear am again as them take waka
near me. “Its you Big T we are calling”
as the chicks near were I dey. Na me be
this oo, wetin una dey find, abi una
done miss road. ‘Not. At all, we have a
message for you’ as one for the chick
follow me yarn. Na wetin con be the
message so. ‘Hon. Osusu Jeremiah
Desmond wants to see you’.

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


πŸ‘‰Please Enter Your E-Mail Address!πŸ“©

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog