Pages

Friday, 28 April 2017

Joke: See As My 5k Just Go Like That

Hello my People,
See as my 5k just go lyk dat
.b4 jamb,I pay one of my guy wey sabi book well well make he teach me..bcus na d same center we dey,we agree say if he cough 1, I go know say na ‘A’ if he cough 2, I go know say na ‘B’
if he cough 3, I go know say na ‘C’ lyk dat dey go o,on friday,
omo real cough cum hold ma guy
,he wan tell me say e bad 4am
but I no dey house, I go drink. On saturday wey b jamb dey , I waka go in place i No see Am
,he wan try explain 4 me say
em condition bad but I no even
listen,b4 invigelator share paper, d guy don cough 1..I say o’boy kul down your blood dey hot,as d invigelator say start, d guy don
cough 2..i say yes o,small tym, d
guy just cough 2..I say no shaking
my guy..i dey number 30 nd d guy dey number 5.,suddenly d guy begin cough lyk celine fan wey spoil o..d guy begin cough
anyhow..i say no lele..after 2mins,
I shout sir am thru’..as I justwan
submit d paper, na so d invigelator just cough 2..i say sir

‘ABEG NA WHICH ANSWER B DAT ?

No comments:

Post a Comment

catigories

ALL IS HERE CATIGORIES
Loading...


👉Please Enter Your E-Mail Address!📩

FOLLOW US ON FACEBOOK
FOLLOW US ON TWITTER
Home | Advertise with Us | Contact Us | About Us | Privacy And Policy | Our Disclaimer |
Copyright © 2015-2018 Freshvibes's Blog™
All Right Reserved..
Blog Crafted by Freshvibes' Blog